published on in Quick Update

Big Brother Naija All Stars housemates: Cece, Frodd, Kiddwaya, Mercy, Pere, odas wey dey Big Brother

23 July 2023

Popular reality show, Big Brother Naija alias BBNaija don return wit di 'All Stars' edition.

Dis na di 8th edition of di show wey dey expected to get plenty controversies as pipo take sabi am.

BBNaija na one of di most anticipated television shows for Nigeria. Dis na sake of di category of pipo wey dey watch am pass - most of which na young pipo.

Di show dey usually dominate conversations for social wen e start up until di end.

Dem select housemates from di See Gobe edition to Double Wahala, Pepper dem, den di Shina ya Eye, Lockdown and Level Up editions too.

For di first time ever audience dey look forward to watching dia favourite housemates from past seasons under di same roof togeda.

Di show dey happun di same year wey BBN organisers run battle between Nigerian and South Africa for dia Big Brother franchise, now dem dey bring back some ogbonge housemates enta house.

Big Brother Naija Legend housemates

Cee-C

Cee-C don become di first housemate wey go join di Big Brother Legend house.

Cee-C bin originally dey as di first runner up for di 2018 edition of BBN.

Cee-C wey her real name na Cynthia Nwadiora, bin dey liked because of her sharp mouth and na wetin almost cause kasala for her for di house as dem bin pair am with Tobi Bakre wey now be actor.

Kiddwaya

Kiddwaya feature for di lockdown version of Big Brother Naija.

Na im love stor with fello housemate, Erica and im dance moves bin create di most ginger for am di friest time wey im enta di house.

Since im comot, im relationship with Erica wey pipo de ship like anoda tin, dat ship crash ooo.

Also, di billionaire son bring im papa Terry Waya to limelight. Im sef don join endorse many products, including im advert for one top hotel for Lagos.

Doyin

Doyin carri herself come from di 2022 season of BBN.

Frodd

For 2019, na Frodd get im own badge as housemate.

Many Nigerians believe say na love mata scata im game for inside di house as im fall for one woman wey dem call Esther for di house sake of say im like her reserved nature.

Frodd bin emerge as part of di five finalist for di Pepper dem season.

As e dey enta di house, e be like love no be im problem again, as im don marry and recently become new papa.

Uriel

Uriel na former member of di Big Brother Naija house. She bin dey di 2017 edition.

Wetin bin sweet fans pass about am na her Big Brother sessions wen she bin dey follow biggie yarn.

As she comot di house Uriel na one of di pipo wey don map ogbonge road for herself as pipo continue dey enjoy her content as she take dem follow her weight loss journey as now she dey call her self fitness lover.

She dey also take tine cook for her ova one million fans for Instagram as she follow call herself healthy cook.

Pere

Pere na 2021 housemate wey bin leave big mark for di hearts of plenti Nigerians.

Im tori for di house get different levels, from di way im bin take dey lead di house wen e be head of house to di way im bin dey tok about im time for di US military.

Two of di biggest moments na how fellow house mate, Maria bin no gree im own for di house and kasala wey bin burst between am and WhiteMoney - wey later win di competition - on top weda cooking na part of strategy for di house.

Princess

Princess bin dey work as taxi driver wen she enta do house newly.

Na her accent catch pipo attention pass anytin.

Wen she comot house like dis na im dem nearly lie for her head say fans buy motor give am but she react swiftly say she neva see any motor oo.

Soma

Soma Anyama na almost first to bounce comot di 2017 edition of di house .

No action from im side during im time for BBNaija but fta di house e make name for imself.

Dis na as im become actor, wit reoccurring role for di TV series for African Magic.

Angel

Angel bin first enta di BBNaija for di Shine Ya Eye edition.

She be one of di controversial pipo for dat season on top her behaviour including di way she dey dress.

She bin get some fight for di house but she bin also get some deep moments as he reveal or inside di season.

Neo

Neo na musician wey enta di house come make anoda singer Vee fall for am for di lockdown season for 2020.

Di mata long sotay even afta di two of dem comot house dem still dey run parol until recently when ship capsize.

Alex

Alex bin dey for di same season of di BBN show with Cee-C.

For her first time for di house na her moves bin take ova contestants for di weekly night parties wey dem bin dey hold.

Wen she comot house wit fellow housemate, Tobi Bakare, e be like ship bin dey start to sail but then again she bash rumours, say di ship na friendship.

Since her time for di house, Alex wey her name na Asogwa Alexandra don dey seen hosting events.

Seyi

Seyi Awolowo na anoda ogbonge housemate wey land gidigba shock everybodi as na di descendant of one of Nigeria founding fathers, Obafemi Awolowo according to tori.

Seyi inclusion bin totori fans on top say e bin dey serve as bartender for dia weekly parties.

Anoda ogbonge moment for im time for di house na im friendship with Tacha afta dem fake evict both of dem.

Ilebaye

Ilebaye Odiniya comot for di third week of di 2022 BBN competition.

Di now 22 year old na criminology and security studies graduate and entrepreneur.

Ike

Ike na American artiste wey enta di house for 2019 wit big plans but end up inside relationship wit di winner for dat year, Mercy Eke.

Afta di show, im and Mercy go on to run dia own reality show but e be like say na for dia di ship take scatter.

Venita

Venita join di 2019 housemates as surprise housemate togeda to wit actor and content creator, Elozonam.

Venita become fan favourite wit di tins wey she bin dey tok for house but e no reach am to win di season.

Adekunle

Adekunle na part of di top four finalist for last year BBN show.

Before e enta di house, Adekunle Tobilola Olopade bin dey work as digital marketing consultant for Lagos.

Tolanibaj

Tolanibaj na pesin wey take centre stage on top her opinionated character for di house wen she bin dey for di lockdown episode.

Tolanibaj bin dey love triangle wit Vee and Neo as she bin don admit say Neo enta her eye.

D mata even cause kasala reach di reunion episode one year later.

Cross

Cross enta do big brother house for 2021 and become di funny pesin for inside di house.

Some of im top moments na wen e fight wit Nini ova bathroom mata and wen e tell Angel say im get dyslexia, wey be learning disability.

Since im comot di house Cross Okonkwo don mistakenly leak nude for snapchat.

Mercy Eke

Mercy Eke na di winner of di fourth season of di Big Brother Naija reality TV show.

Afta plenty drama, romance plus fight fight inside three months, Mercy ova take Mike wit 41 per cent to win di Big Brother Naija reality TV show.

Whitemoney

Na Whitemoney win di big brother Naija season 6 reality TV show afta 10 weeks inside di 'shine ya eye' house.

Whitemoney wey im real name na Hazel Oyeye Onou beat ova 20 housemates wey participate for di sixth season of di show.

Di 31-year old Whitemoney come from Enugu state say e be businessman wey dey into import of shoes.

ncG1vNJzZmivp6x7o67CZ5qopV%2BltqWzyKdmb25ibYJ4gZQ%3D